🚨PELLER & GEHGEH DON START AGAIN OO 🤣‼️

Omo wahala no dey finish!
There’s one guy for TikTok wey dem dey call Fearless. The guy dash Peller bracelet worth $30k (about ₦50M) for Seyi Vibez concert wey happen for Lagos 3 weeks ago — that same show wey plenty TikTokers dey do livestream.

Fast forward to today, omo Fearless don cry enter Prof Gehgeh lecture room. While class dey go, na so him dey lament say: “I don make financial mistake o!” 🤦🏽‍♂️

Him talk say he hear Peller just buy mansion worth over ₦500M, meanwhile him wey gift am bracelet still dey squat for rented apartment. Chai, Prof no waste time, he turn am to class topic straight:

1️⃣ Either you be man or woman, never inconvenience yourself just to impress others.
2️⃣ No be every mistake be “devil’s work” — sometimes na over high service dey send person back to village.
3️⃣ You no be people’s happiness plug! No dey sad just because you wan make others smile. If dem dey depressed, abeg make dem go watch Sabinus skit. 😂

Lesson of the day: If no be say Fearless no dey fear, he get mind dash him boss ₦50M bracelet just like that 🤣.

🔥No be gist if Naijagist no gist am!🔥

image