10 ์•ˆ์— - ๋ฒˆ์—ญํ•˜๋‹ค

๐ŸšจPELLER & GEHGEH DON START AGAIN OO ๐Ÿคฃโ€ผ๏ธ

Omo wahala no dey finish!
Thereโ€™s one guy for TikTok wey dem dey call Fearless. The guy dash Peller bracelet worth $30k (about โ‚ฆ50M) for Seyi Vibez concert wey happen for Lagos 3 weeks ago โ€” that same show wey plenty TikTokers dey do livestream.

Fast forward to today, omo Fearless don cry enter Prof Gehgeh lecture room. While class dey go, na so him dey lament say: โ€œI don make financial mistake o!โ€ ๐Ÿคฆ๐Ÿฝโ€โ™‚๏ธ

Him talk say he hear Peller just buy mansion worth over โ‚ฆ500M, meanwhile him wey gift am bracelet still dey squat for rented apartment. Chai, Prof no waste time, he turn am to class topic straight:

1๏ธโƒฃ Either you be man or woman, never inconvenience yourself just to impress others.
2๏ธโƒฃ No be every mistake be โ€œdevilโ€™s workโ€ โ€” sometimes na over high service dey send person back to village.
3๏ธโƒฃ You no be peopleโ€™s happiness plug! No dey sad just because you wan make others smile. If dem dey depressed, abeg make dem go watch Sabinus skit. ๐Ÿ˜‚

Lesson of the day: If no be say Fearless no dey fear, he get mind dash him boss โ‚ฆ50M bracelet just like that ๐Ÿคฃ.

๐Ÿ”ฅNo be gist if Naijagist no gist am!๐Ÿ”ฅ

image