10 āĻ­āĻŋāϤāϰ⧇ - āĻ…āύ⧁āĻŦāĻžāĻĻ āĻ•āϰāĻž

🚨PELLER & GEHGEH DON START AGAIN OO đŸ¤Ŗâ€ŧī¸

Omo wahala no dey finish!
There’s one guy for TikTok wey dem dey call Fearless. The guy dash Peller bracelet worth $30k (about â‚Ļ50M) for Seyi Vibez concert wey happen for Lagos 3 weeks ago — that same show wey plenty TikTokers dey do livestream.

Fast forward to today, omo Fearless don cry enter Prof Gehgeh lecture room. While class dey go, na so him dey lament say: “I don make financial mistake o!” đŸ¤ĻđŸŊâ€â™‚ī¸

Him talk say he hear Peller just buy mansion worth over â‚Ļ500M, meanwhile him wey gift am bracelet still dey squat for rented apartment. Chai, Prof no waste time, he turn am to class topic straight:

1ī¸âƒŖ Either you be man or woman, never inconvenience yourself just to impress others.
2ī¸âƒŖ No be every mistake be “devil’s work” — sometimes na over high service dey send person back to village.
3ī¸âƒŖ You no be people’s happiness plug! No dey sad just because you wan make others smile. If dem dey depressed, abeg make dem go watch Sabinus skit. 😂

Lesson of the day: If no be say Fearless no dey fear, he get mind dash him boss â‚Ļ50M bracelet just like that đŸ¤Ŗ.

đŸ”ĨNo be gist if Naijagist no gist am!đŸ”Ĩ

image