ЁЯЪиPELLER & GEHGEH DON START AGAIN OO ЁЯдгтА╝я╕П
Omo wahala no dey finish!
ThereтАЩs one guy for TikTok wey dem dey call Fearless. The guy dash Peller bracelet worth $30k (about тВж50M) for Seyi Vibez concert wey happen for Lagos 3 weeks ago тАФ that same show wey plenty TikTokers dey do livestream.
Fast forward to today, omo Fearless don cry enter Prof Gehgeh lecture room. While class dey go, na so him dey lament say: тАЬI don make financial mistake o!тАЭ ЁЯджЁЯП╜тАНтЩВя╕П
Him talk say he hear Peller just buy mansion worth over тВж500M, meanwhile him wey gift am bracelet still dey squat for rented apartment. Chai, Prof no waste time, he turn am to class topic straight:
1я╕ПтГг Either you be man or woman, never inconvenience yourself just to impress others.
2я╕ПтГг No be every mistake be тАЬdevilтАЩs workтАЭ тАФ sometimes na over high service dey send person back to village.
3я╕ПтГг You no be peopleтАЩs happiness plug! No dey sad just because you wan make others smile. If dem dey depressed, abeg make dem go watch Sabinus skit. ЁЯШВ
Lesson of the day: If no be say Fearless no dey fear, he get mind dash him boss тВж50M bracelet just like that ЁЯдг.
ЁЯФеNo be gist if Naijagist no gist am!ЁЯФе
Wilson Abavo
рдЯрд┐рдкреНрдкрдгреА рд╣рдЯрд╛рдПрдВ
рдХреНрдпрд╛ рдЖрдк рд╡рд╛рдХрдИ рдЗрд╕ рдЯрд┐рдкреНрдкрдгреА рдХреЛ рд╣рдЯрд╛рдирд╛ рдЪрд╛рд╣рддреЗ рд╣реИрдВ?
Nwaonye Kingsley
рдЯрд┐рдкреНрдкрдгреА рд╣рдЯрд╛рдПрдВ
рдХреНрдпрд╛ рдЖрдк рд╡рд╛рдХрдИ рдЗрд╕ рдЯрд┐рдкреНрдкрдгреА рдХреЛ рд╣рдЯрд╛рдирд╛ рдЪрд╛рд╣рддреЗ рд╣реИрдВ?